Home Sports Bayer leverkusen don end Bayeer munich reign.

Bayer leverkusen don end Bayeer munich reign.

181
0

Bayer leverkusen don end Bayer munich reign.Them win the germany title.

Bayer Leverkusen nack Werder Bremen 5-0 for Sunday, carry dia first-ever Bundesliga title afta 120 years, burst Bayern Munich 11-year hold for German title.

Xabi Alonso’s Leverkusen bin control wella and dominate even though say na big occasion, Florian Wirtz score hat-trick, Victor Boniface and Granit Xhaka add join, wey make dem no lose for 43 games for all competitions.

Leverkusen no dey among favorites for di title when season start, Bayern dey expect to win 12th time straight, and people dey look Dortmund as dia closest rival.

But Spanish coach Alonso don guide im team near to di first invincible season for Bundesliga history, with German Cup final dey come and Leverkusen still dey inside Europa League.

With five games to go, di new champions don gather 79 points, wey be 16 pass second-placed Bayern. Dem still break Bundesliga record for longest unbeaten run for one season.

Some of dem wey shine pass for dia team include left wingback Alex Grimaldo, wey dem sign free for di season start, oldie midfielder Granit Xhaka, Florian Wirtz wey na home talent wey score three goals on Sunday, and Nigeria striker Victor Boniface wey don chop five Bundesliga rookie award this season.

Dis first title win come afta five times wey dem finish second for dia history.

Dis tori still dey develop, more details go land for Intel Region WhatsApp group soonest.

 

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here