Charly Boy made the remark in a post he wrote in Pidgin on his X page.
Charly Boy wrote: “My people, make we yarn truth without sugarcoating. Bola Ahmed Tinubu waka go UK go greet big men, but for house, fire still dey burn. Na who dey deceive who? You leave problem for ground, carry full convoy go snap picture for palace.
“Dem go say na to build relationship, sign agreement, do big big talk. But abeg, if light never stable, security never sure, and people dey cry, which agreement wan first work?
“Even worse, na full squad dem carry go. Governors, ministers, everybody wan show face. E come be like say governance don turn group excursion.

“Meanwhile for places like Borno State, people still dey face serious wahala. But our oga dey smile for international camera. Life no be Instagram filter.
“If your house clean, you no go need go outside go beg for validation. Your people go stand gidigba for you.
“But when ground no balance, even golden handshake go feel like empty promise. Nigeria, open your eye well. This film we dey watch, na rerun.”

Join Our Social Media Channels:
WhatsApp: NaijaEyes
Facebook: NaijaEyes
Twitter: NaijaEyes
Instagram: NaijaEyes
TikTok: NaijaEyes




