Home Crime Dispatch rider say him help Emefiele theft money.

Dispatch rider say him help Emefiele theft money.

228
0
EMEIFELE AND THE FORTY THIEVES
How a dispatch said he helped the former cbn gov to divert funds.

Dispatch rider talk how him helep Emefiele carry $3 million cash from CBN, im testify for court.

One dispatch rider, Monday Osazuwa, don talk for court how di former CBN Governor, Godwin Emefiele, bin send am go collect $3 million cash on different occasions.

Osazuwa, wey bin dey give evidence for court, talk say im bin dey work for Zenith Bank for 2001 before im join CBN for 2014.

According to Osazuwa, Emefiele bin send am to collect di money for am wen Emefiele dey Lagos. Emefiele go tell am make e give di money to second defendant, Henry Omoile, if Emefiele no dey around.

Osazuwa add say Emefiele bin send am go MINL Limited when e bin dey work for Zenith Bank to collect cheques wey e go give back to Emefiele.

Osazuwa talk say im dey faithful for im work but Emefiele no ever give am reward.

Justice Oshodi don grant Emefiele bail for N50m with two sureties wey go show say dem get work and don pay tax for Lagos State for three years.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here